Dreams can be frustrating to bring to pass
Nor be small cry that afternoon oh, myma say she wan call her pastor make he con lay hands on me make the spirit wey dey disturb me leave me, she con carry phone call John, he nor pick, I con thank God.. Before I know John don call her back nai she put the phone for speaker dey tell John say I wan kill her,say I say na 419 work I wan do with my life now, I nor know much about the work so I nor con fit talk.
If talk dey kill person that day I for die, eh nor get word wey myma and John nor tell me .... but cause Peter never tell me wetin the Yahoo Keke dey about I just keep quiet... John con tell myma say make she go register me for tailor shop tomorrow when I close for school so I go start to dey learn now now, John dey very concern about me, he say he nor wan make I join bad gang, nor be say I like bad gang, I just want to make money, nor be only John go dey give me money.
After John cut the call that afternoon, myma con go outside go make call....Me I nor Kuku care who she dey talk with, I enter kitchen go swallow the hot eba wey she make wait for me....as I dey swallow the eba my mind dey tell me say make I eat fast make I go play ball small with some boys for the area, I say no that one go make myma vex more, for today when I eat finish I go wash plate then bathe,after I go try read small book, wether small thing go eater the head, even though mama John don already register me for special center cause of my coconut head....
I don do all wetin I wan do finish,I con lyedown for the long chair wey dey myma parlor the worst mistake wey I make, the sleep don carry me go far....I con dey dream sweet dream wey I dey spend lot of money before I hear na tway tway....I shout "Jesus Jesus ahh" na myma and him pastor na dey flog me holy ghost cain, I nor remember if I don ever cry but that day I cry like say I be two years old....myma say make her pastor flog the juju comot for my body...ahh wey I wan run go dem lock the door...
I see wetin I never see for my life that day if eh get wetin I want that evening nor be money na how I wan take come out alive cause eh be like myma pastor get me for mind, I sha speak in tongues that night.
The next day I nor wan go school I con form sick,the cain mark for my body nor be small....myma con pet me say her pastor take the beating serious at the same time she say naim good for me....Myma con make hot tea for me with bread con put plenty butter for the middle... ahhh I con remember say Peter tell me say na today he go tell me about him Yahoo keke work, and I nor get phone if not I for call am....myma na tell John say I nor need phone until I finish secondary school, John con gree as the good son wey he be....