Chereads / Yahoo Keke / Chapter 5 - CHAPTER FIVE

Chapter 5 - CHAPTER FIVE

Yahoo Keke

Nor be small beg I con beg myma cause if myma comot hand for my body nai be say John nor go reason me again for this life, and if John nor reason me,no Keke no money no nothing....Myma con say she nor wan hear the matter for my mouth again...I tell her say I hear.

When Peter finally come school eh reach two weeks, exam time don already reach, he say dem carry am follow travel go Dubai cause he be beta person! Ahhh your own good...I don comot my mind for Yahoo keke matter for now cause myma nor gree buy Keke for me na so I tell Peter, ah ah why you nor tell me say you wan Keke na, Peter con ask me...but I tell you say I wan tell myma make she tell my bross make him buy for me na...I don forgot oh but I get wan old Keke sha wey dey in good shape,I dey wan sell am before I fit leave am for you base on say you be my person,na so Peter con talk....aahh ma oga,ma oga...I just dey shout anyhow....shut up you fool wetin reach oga na,you go pay me when you don dey collect money for street nor be dash..na so Peter con talk!

Ahh no quams na bro, as long as you go put me through and I start to dey see money I go surely pay you,even add something join... Peter say no problem!

That day my joy no get second,I happy die aahh Peter my rere gee, he wan make my dream come true.

When dem close I go carry you go see the Keke,i go still teach you how dem take dey ride am if time still dey, na so Peter con talk, Ok no quams,I dey bam I con tell am.

We con reach Peter house,no be small thing I see oh, this guy dey stay on him own, two room with parlor and toilet and kitchen inside..ah ah Peter I nor know say you be bra like this oh...leave that thing Inno, when you start just now you go level up once.

Peter give me alcohol, I tell am say I nor dey drink,he con dey laugh me say I be mugu,I say myma nor dey like am nai make me never reason to drink,he con give me juice and biscuits wey eh get levels, say na chocolate biscuits wey him bring from Dubai, me too don use style enjoy life.

We con go the back of him compound he pack him Keke dem dey, he show me the one wey him wan give me,the thing nor even old..I con dey wonder why him buy another one,at the same time my belle sweet me cause na him don make me get Keke...we con ride go where him wan take teach me....when we start Peter con shock sef the way I take ride the Keke...I con tell am say na my calling.

This happiness wey I feel nor get second I don get Keke,how mama John go feel? nor be now I go think that one...