I reach house I act like nothing happen,myma say my food dey kitchen make I eat make I dey go the tailor shop, I say I hear, overjoy nor let me eat even as na food wey I like well well... myma waka come meet me say why I dey happy, I tell her say I nor dey happy say even if I dey happy na cause say exam dey start next week....myma con say ok.
As I reach my oga tailor shop I just dey smile anyhow Hazizi con ask me say wetin happen to me,say I change...I con tell am say my dream don come true,say the reason wey make I come today na cause say I nor go dey come again,he con ask me say wetin I mean...I con tell am say I wan dey go ride my keke every day when I close from school...so if our oga ask make he tell am say he nor know why I nor dey come...say na for the main time,once I don make plenty money I go con sew cloth for him hand...
Hazizi say make I nor do like that, say make I nor do like that say make I wait till after my exam, so I nor go fail, I tell am say make he no worry about that one say myma don pay for correct place for me to write my exam...
The next day I con put cloth for bag, I tell Peter say I go like make we start that day, he agree...as I reach Peter house the guy con dey laugh me say I still be baby, say the street nor be for Mama's boy, I tell am say I nor be Mama's boy, na 17 years na I enter last year, myma just dey hold me with tight hand cause she nor want make I join bad gang...I nor talk am Mama's boy, all the time myma,myma,myma abeg make we dey go, na so Peter con talk.
We con go do the training for the open space,Peter say he nor wan hear say I use him Keke get accident or kill person...he con dey over dey act sha but I nor mind cause na me dey find something, as we dey learn Peter con get call, he say na one of him Oga, he say na small boy oh but he get money well well.
I con dey rush Peter say make we dey go now now he say him Oga say he dey somewhere dey buy something say he nor wan use him car take carry am say he go call Peter once he buy finish, I con say ok...
Aahh my blood dey hot, Peter say he wan show me to him Oga if him nor fit come so I go dey go, aahh correct guy, aahh you pass blood oh na so I con tell am....aaahh I nor fit wait.
The call con come we con enter road go meet the Peter oga.
As we reach the place the person dey inside,Peter con show me him car for the outside na the lastest Lexus Rx350... aaahh my body shake,my full mind dey...Peter con call him Oga say he dey outside as he show out na who? How he take be, no na?!!