Yahoo Keke
The next day I enter school like say nothing happen,as I enter class I see Peter my mind over sweet me,the Yahoo keke work don sure....I don already make up my mind say I nor go tell myma anything again... I quick quick sitdown near Peter,I con ask am hawfa, he say he dey why I nor come school yesterday,I con lie give am say I sick yesterday, he con say when we dey break he go tell me wetin he work dey about, I nor sure say I don happy the way I happy that morning for class .
As dem just ring the bell na so I just dey smile anyhow, I swear all wetin dem teach before dem ring the bell I nor hear one....as we reach wey we dey sitdown for break Peter con tell the other guys dem say make dem leave us small say he get wetin he wan tell me, dose ones nor care cause Peter dey bless dem wella..
He say first you need to know wetin be Yahoo, I con say ok , he say Yahoo na people way dey do internet fraud, so Yahoo Keke na people way dey drive this fraud people with Keke,I con say ooh ok..
He say dem dey pay well well oh, he say even if na small place you carry dem go dem go bless you wella...my full mind don over dey as I hear that one.
Peter say yesterday he nor almost wan come school cause before he enter house say na 12am with almost 30k cause the guys wey he dey carry nor dey gree use their cars when dem dey go club, say dem dey even dey treat am like one of dem, say he eat and drink taya,aahh na my life you dey live oh, na so I tell am...he con dey laugh me, say I be big fool.. the guy like the word well well but I nor dey mind.
School con taya me that day, how I wan take make mama John agree make John buy Keke for me na I con dey think...One idea con dey my mind,I say I go go the tailor shop go dey learn den once eh don reach like two months I go beg myma say make she tell John make he buy Keke for me,so I go dey do am as my side hustle.
My body con dey shake, I dey think how I wan take tell myma..... when I reach house she nor gree do food wait for me say we dey go the tailor shop,as we reach dey she just tell the man say na him be this, haha mama John you don first come here?...na so I ask her inside my mind, he go start today.. before I close for dey I tire... sleep wan finish me.
Myma tell the man make he handle me with strong hand.
The next day Peter nor come school,I just know say evrywhere good for am yesterday night...ahh