Yahoo Keke
School nor just sweet today... even with the fact say I get enough money for pocket to buy things for people,I nor just happy.... Peter don turn my padee, he too get doings...as he nor come school I nor con dey feel the school at all....I don think taya,maybe na club dem go last night oh na make am nor come....that one na him own sha, how i wan take go this tailor shop for two months before I go tell myma about the Keke na...only yesterday the thing don taya me.
As break reach I con buy things for people normali,but dem con dey ask about Peter..One yeye girl even get mind write her number give me say make I give Peter, I just ask her say as wetin? I voltage follow am... sorry sorry na she talk...I waka leave am.. aahh the thing pain me...I vex till school finish, I con change my mind say I nor go wait till two months time again as I reach house I dey tell myma say I need Keke.
As I reach house everywhere dey smell nice, myma sabi cook sha,as I enter the kitchen na I greet myma she con tell me welcome, say make I change con eat fast so I go con dey go the tailor shop,I rush enter my room wear one short kneca wey I like well well....I carry the food, I nor sure say anybody sabi cook beans reach myma, na so the dodo full the plate...I eat finish sweet sleep con just carry me go...na once she knack my head say make I enter road dey go the tailor shop na "aahh mama na!
I con gada mind wan tell her.. as I just say Keke,na once myma start to shout, I say mama John nor be Yahoo Keke I wan do again oh, she nor even wan hear me... before I see she don dey call John na once I enter road oh...I nor get body for preaching.
As I reach the tailor shop I con see two people wey I nor see when I come before, the oga con say dem be my senior for the work, I con say ok...the oga con say as the junior for the work I need to dey respect dose guys say anything wey dem tell me na I go do.. aahh ok na so I con answer am... Wetin be your name one of the senior wey dem dey call Hazizi con ask me ,I say Innocent,Inno for short, na so this short girl wey oga say be my senior too con dey laugh no be small...nor be only Inno for short na Inner with him lizard neck...eh do na the only thing wey oga talk... Myma!!!! Mama John!!!
Hazizi say make I nor mind Agatha na be her name... say na so her character bad.... I happy small cause Hazizi na correct guy...if nor cause say I don put my mind for this Yahoo keke I for cause of am become tailor....
I reach house that evening nor be small thing oh, myma say make only me go do eba oh, say since I don agree to be Yahoo keke say she nor get hand for my life again...ha ha mama wetin reach so na?... na so I ask her.