Chereads / Yahoo Keke / Chapter 13 - Core warning but I nor go hear

Chapter 13 - Core warning but I nor go hear

As I reach Peter house him dey house, I park my Keke con knock him door, Peter con say Inno why you dey smile like who win jackpot, I con tell Peter say this one pass jackpot oh... Peter con say wait first make eh nor be wetin I dey think oh...I con ask am say wetin you dey think Peter?

You don see Oga Kush smallie Peter con ask me, I con start to dey laugh like fool oh, I con tell Peter say yes wetin happen?

Peter con say Inno comot your mind for that babe body if you never wan die, Oga Kush go do you dirty for that him smallie matter.

The reason why I take you go meet am make you for work with am nor cause say I nor like work with am, na cause of wetin I see am do person cause of him smallie.

Wetin Peter dey talk,my full chest don dey for this girl matter na so I con dey talk for my head.

I con tell Peter say I nor fit comot mind for the girl matter, Peter con ask me say nor be Yahoo keke work I wan do again?

I con tell Peter say for this girl I go leave the work oh,say eh nor get wetin him wan tell me for this girl matter.

Peter con tell me say him self don like the girl past,say him use system tell Oga Kush say him smallie nor bad, na Oga Kush give am strict warning,and anytime him see the girl him mind dey dey na make am say him nor go work for am again oh

I con tell Peter say thank you for wetin him do so, na him don bring me to the love of my life, Peter just weak dey look me..say na my problem be that him don tell me him own, I con tell Peter say I hear.

I con ask Peter say by the way you cook?.. you nor just well na so Peter con tell me,go the kitchen I leave small beans for you ..aaahhh as I hear beans I con remember myma award winning beans...

You sure say this your beans wey dey white like wetin dem nor put palm oil go sweet so na so I con tell Peter

You be fool na so Peter con tell me.

Guy belike I go soon dey go house oh na so I con tell Peter..I nor want make myma con dey vex more for me, since morning na I dey outside.

Peter con say why I nor move con him house,I con tell am say eh nor bad before but nor be now, myma nor go like the idea.

Myma myma you nor go grow up oh,with this your childish behavior na you wan take go talk to girl,fool! Na so Peter con talk.

Ha ha wetin reach so na I con tell Peter, Myma never forgive me for the one wey I say na Yahoo keke work I wan do you want make I move out from myma house? Just kuku say you want make I be prodigal son na so I con tell Peter.

Peter con say you nor be prodigal son before? You wey your mother and brother dey take care of you say you wan do am by your self,you be better prodigal son,he con laugh join.

I nor blame you na, nor cause say I never get better money to rent house na make you dey see me finish...I con tell Peter.

Peter con say and the money to buy Keke too, idiot he con still dey laugh..I nor vex cause Peter nor dey take him talk seriously, na just joker na him be.

Abeg I dey go..see finish don start,na so I con tell Peter,

Ehehn...how much Oga Kush pay you for the work today...na so Peter con ask me.

I nor collect money today na so I con tell Peter,see this fool oh cause of woman wey you carry you nor collect money, na so Peter con tell me.

I con tell am say nor cause of woman, I tell Peter say na cause of the phone wey him give me.

Peter con say that one nor bad, one good turn deserve another but still him feel say na cause of the girl ..deep down I know say na cause of the girl I nor collect money,I want make she dey reason me... I con tell Peter say bro na later make I go myma house first.

As I enter outside of Peter compound na my phone con ring I just know say na Oga Kush, cause na only him na get the number,I con pick the call.. Oga Kush con say

"" why you nor see me before you go,you nor even wait to know if I get another thing wey I need you to do"" I con tell Oga Kush say make him nor vex.

Him con say no problem make I come back fast...I don drop the Keke key with Peter before,I con enter him house back... Peter con ask me if I forget something.

I con tell Peter say Oga Kush call me come back,say him still get work for me,I con tell Peter say before I go go him place come back say time go don reach 6pm oh,and I nor even sure if eh nor go pass.

Peter con say make I go first,say Oga Kush nor dey keep late night,say even if him nor quick free me I go sleep him house....I con tell Peter say thank you!.

Peter na my correct guy,I nor know how me Inno take dey lucky with this kind friend.

Ok na my guy na later things,na so I con tell Peter... Peter con say no quams!