Chereads / Yahoo Keke / Chapter 14 - Beating wey dey format brain

Chapter 14 - Beating wey dey format brain

I con enter my Keke,I con ride am very fast say this one wey oga Kush say make I come back so say na very important thing him want make I do for am,as I dey rush I nor take note of the policemen wey dey by the side of the road.

Na once one of dem stop me, I been wan doge am but eh nor get how I wan take do am the place wey him for corner me na one tight corner, I con dey ask am say ""wetin happen na I dey rush dey go somewhere ""

The policeman con dey tell me say ""where I dey rush dey go say wether I dey plan to kill person?""

Aaahhh baba I nor fit kill person ohh, person dey wait for me na make I dey rush na so I con tell am.

The policeman con say where the papers of the Keke, I con give am he con look am for some time like say him dey find something,I con tell am say everything correct for there, na once him vex con dey tell me say make I come down, say him dey feel say I thief the Keke,aaahhh popo! I nor thief Keke oh na so I con shout..

""You dey shout abi?, You never see anything""

Aaahhh I don enter one chance oh,na so I con dey talk for my mind,the popo con say make I bring my phone say you this small boy who get the Keke,you thief,na my friend Keke,him dey use am dey help me till I go see money buy my own,ole thief, you don thief person Keke.

Na once I remember say you nor dey fall mugu for this country popo,if you do,dem go turn you to market, na I tell am say I go call my Oga wey I dey go meet,I con dey voltage so dem go fear small, na once the popo give me the papers back, him con say make I dey go,say this one nor get money.

Na I enter road dey go,as I reach the gate na I call Oga Kush say I dey him estate oh,him con ask me say why I con tay again na,na I tell am say na popo burst me for road oh,na him say ehehn I dey come, I con tell Oga Kush say ok.

Him con come out with two harvy guys, I con dey say this Keke go reach this people so for my mind, na Oga Kush con say make I come down first,I nor reason anything I con come down,say maybe him wan talk to me,the guy na correct guy na so I con dey reason.

As I come down na once this two harvy guys just hold me I con first dey reason say maybe na something or the other my mind nor go him smallie at all,na once dem carry me enter the compound.

Inside the compound fine well well, something like grass dey reach the door,him get gym for the compound,those type of instrument wey dem dey use for oyibo own,na once dem lie me for one table,I never still get wetin dey happen.

I just try you once you fall na so Oga Kush con talk,I con say boss man I nor understand,him con say why you dey smile for my smallie anyhow, you con even ask am her name!... Aaahhh Jesus!!!!!

Boss na devil work, I nor even like her at all na just for asking sake,why you con dey smile like fool,I nor understand oh boss,na once him pull him belt begin dey flog me,say ""I go focus for my work abi I nor go focus?""

Aaahhh Jesus!! Aaahhh Jesus!!

""You even carry her you nor wait collect money,you know how fuel cost?""

Peter na dey buy fuel for that Keke for you abi na lie? You get mind dey like woman,you go focus abi you nor go focus ""

Aaahhh eh get wetin Peter never tell me, how Oga Kush take know? Na so he continue to dey flog me oh, I con dey cry dey beg ohh, I say I nor go reason girl again,say I go focus...but him nor stop oh all my yansh don boil...aaahhh Jesus!!

I nor go do again oh,I nor go do again,na so I con tell Oga Kush, him con answer say I nor get right to talk that one,say Peter nor fill me in,say na him buy the Keke give am,say na him even still give Peter the other Keke after Peter serve, why I feel say Peter tell me to con work for am...I con say Peter nor tell me oh,he say now I don know,say if I nor do again he go carry the Keke give another person.

He con flog me for another two minutes him con tell the guys say make dem leave me,say this beating na to format my brain say make I nor try am carry him or another person for free again,I con tell Oga Kush say I hear.

Him con collect one bag from one of the guys,con give am to me say inside the bag na 150K say the money na for me to buy new clothes and drugs for myself, say the other thing wey dey the bag na ""Kush"" say na for me to deliver tomorrow morning,say the address wey I go deliver am to dey inside the bag,say dem don already pay for am and dem dey expect am for morning so make I nor late,I con say ok sir I nor fit even stand well him nor dey even dey reason me.

Say if anything lost inside say I go go jail.

At this point I nor know wetin I con dey reason again, wetin I don enter, myma warn me oh, Peter nor tell me say na drugs him dey push with him Keke oh,I nor sure say I wan do this Yahoo keke work again oh!